Heloooooooo every aauites outdea, how una dey, hw body be bros and sixtas, eehn? Shey una dey dowload and upload? How the weather for your side? hot or cold....d weather no dey friendly dis days at all e dey hot over here for akungba so teh we aauites dey think say maybe the angel wey dey akungba town sun control room dey always sleep wey e no dey knw d time to regulate am...this time u go see all this yellow pawpaw babe turn black mango overnight,...bros wey reason the babe mata for night go come dey deny her for morning...e no good oo but kilode tehn bora...abeg shey na d bros fault..eenh? Make una take break from cream for now my sistas, that one no b big deal sef, the big deal na d akungba igbeyin wey dey ravage everywhere now, wetin happen for my class today, make me laugh so teh i started crying u wan knw wetin happen? I go tell u, i no dey amebo stingy only money stingy...today one of dis so called big girls dey vomit garri, her friend com see garri ask her say, Cynthia, shebi u talk say na sharwarma u chop dis morning, dis girl ansa sey she no undastand hw e take happen, i beg shey sharwarma come turn garri inside her nii or wetin happen my brother...nothing more dan akungba igbeyin... i no fit laugh...yes its your boy..no your guy Moses right here on AAUAHOTSPOT FM, we are in the 4th week of the second semester exam, exam stil continue and i pray all the witches and wizard wey dey fast for your failure and F's naa the fast go kill dem..can i hear you say Amen, hmmm i trust my fellow aauite, na dis kind time all of them dey go spiritual, u go dey hear brother lagbaja sister tamedu if u notice for my side sef, i don turn Moses, no be Eric again, yesterday i see one of dis street nigga, i mean real nigga they go church, i no believe wetin i dey see, i near am ask say wetin happen, my guy say na bcos of exam...hahahaha...i beg u too join ooo
my fellow aauites its the 5th day of the VC attacked, d culprit have been found and suspended till further notice....this days, we are seeing some hostelite carrying brekete load commot for hostel, i hope na holiday dem dey go and no b say dem dey park commot...
before i continue my amebo lets read some paid advert

ADVERTISEMENT:
SINGLE ROOM AVAILABLE @25K (18K SUBSEQUENT YEAR, VERY NEAR THE CAMPUS) @17K (12K THE FOLLOWING YEAR, 15 MINUTES WALK TO CAMPUS) SELF CON AVAILABLE @ 60K (50K THE FOLLOWING YEAR, VERY VERY NEAR CAMPUS, TILES, FENCED, BOREHOLE) if you need any of this room kindly call 08102345751 or inbox AAUAHOTSPOT BY CLICKING THE LINK http://fb.com/aauahotspot

ANTICIPATE DAMZY FOR SUG OO3
Yes yes yes, welcome back from our sponsors, so how una dey all aaua fresher, shey una dey enjoy, shey u dey fresh, AAUAHOTSPOT greet u oo, by ending of march or early april una too go don dey here, AAUA sweet oo, if na for book, e sweet, for flex e sweet, for hmmm e sweet but wetin spoil am na d one day ON one dey OFF light but still sweet..., make una stay calm, we @ AAUAHOTSPOT are preparing necessary measures to help you during your registration and render you cheap services compare to other exhorbitant charges by other internet business serivce, YOU CAN ALWAYS FIND HOTSPOT AT MRC, OR CALL 08102345751 we render good and fast service....and lastly to all the predites, we hear amebo say your list we be released this month so make una dey prepare to resume by march...na here we go stop for now for today, i remain my humble sef, MOSES and till next week aauites....stay alive and alert.
AMEBO Season 1
Reviewed by Oluwadamilare
on
5:15 pm
Rating:
No comments:
We Love Comment
Its like fuel in our Engune