Tweets

AAUA AMEBO SEASON 1 with Eric Freelance

Heloooooooo every aauites outdea, dem JJC and the staylites
how una dey, hw body be bros and sixtas, eehn?
Shey una dey dowload and upload?
How the weather b for your side? hot or cold....d weather no dey friendly at all for here ooo, e dey hot over here for akungba so teh we aauites wey dey ground dey reason say the angel wey dey akungba town sun control room dey always sleep wey e no dey knw d time to regulate am even for cold weather

Na for akungba you u go see all this yellow pawpaw fresher babe turn black mango within 2 weeks of resumption,.. that one no b big deal sef, the big deal na d akungba igbeyin wey go ravage everywhere towards exam, wetin happen for my class during my 100 level days, make me laugh so teh i started crying anytime i remember u wan knw wetin happen? I go tell u, i no dey amebo stingy na only money stingy...

Then, one of dis so called big girls dey vomit garri, her friend com see garri ask her say, Cynthia, shebi u talk say na sharwarma u chop dis morning, dis girl ansa sey, she no undastand hw e take happen ooo, i beg shey sharwarma come turn garri inside her nii or wetin happen my brother...nothing more dan akungba igbeyin... i no fit laugh...yes its your boy, your guy , your partner in crime, your padi, your crush... right here on AAUAHOTSPOT FM this morning, we are in the 1st week of 2015/16 session,

before i continue my amebo lets read some paid advert

ADVERTISEMENT:
SINGLE ROOM AVAILABLE @25K (18K SUBSEQUENT YEAR, VERY NEAR THE CAMPUS) @17K (12K THE FOLLOWING YEAR, 15 MINUTES WALK TO CAMPUS)

SELF CON AVAILABLE @ 60K (50K THE FOLLOWING YEAR, VERY VERY NEAR CAMPUS, TILES, FENCED, BOREHOLE)

if you need any of this room kindly call 08102345751 or inbox AAUAHOTSPOT BY CLICKING THE LINK http://fb.com/aauahotspot

Yes yes yes, welcome back from our sponsors,

so how una dey all aaua fresher, shey una dey enjoy, shey u dey fresh, AAUAHOTSPOT greet u oo, by middle of January, una too go don know what's up..You know what im saying? , AAUA sweet oo, if na for book, e sweet, for flex e sweet, for hmmm e sweet but wetin spoil am na d one day ON one day OFF nepa light but e don dey stable sef...Thank God

Make una stay calm ooo, make you no go fall for all this wicked people magomago for your online screening registration starts 20th december, next week.

We @ AAUAHOTSPOT have already prepared necessary measures to help you during your registration and render you good and secure services

Make una come ooo, make you no fall victim of all this fake registration center we take God beg you

Our Offfice: FIND HOTSPOT AT MRC (Mass Communication Relaxation Center) , OR CALL 08102345751 we render good and fast service...

i remain my humble sef, Eric Freelance and till next week aauites....stay alive and alert.


FOR MORE AMEBO,TIPS,HELP click the link http://fb.com/aauahotspot
KINDLY SHARE
AAUAHOTSPOT
AAUA AMEBO SEASON 1 with Eric Freelance AAUA AMEBO SEASON 1 with Eric Freelance Reviewed by Oluwadamilare on 12:16 am Rating: 5

No comments:

We Love Comment
Its like fuel in our Engune

Ads Inside Post